Erigga - Delete Lyrics

bottles up! put dem in the air
men dey talk, i know wetin i hear
live my life, like ion really care
cos when e bust
p_p_ple
when he bust
p_p_ple
when e bust
people dey delete

men go stab your back ask you why you dey bleed
their plan na to bury me but Erigga na seed
Iffa dey yan my mind dem go say na weed
so i keep my ish to myself, i don see am no need
cos at the end men go do wetin sweet dem
but karma know their address charter keke meet dem
your man go hide stain your clothes becos he dey sell bleach
to quensh you nor go hard am like benson swish
weda you play your piano or dey into music
make your money leave poor man with excuses
the way my circle take small like okro muni
na beta pass, snake dere nor fit wound me
i nor fit use my two legs test weda river deep
reduce the hennesy, iffa hear say liver cheap

king of the south, nor dey binu for my leadership

enjoy the voyage, yus take am say na symbal ship

bottles up! put dem in the air
men dey talk, i nor wetin i hear
live my life, like ion really care
cos when e bust
people dey delete
when he bust
people dey delete

when e bust
people dey delete

when e bust
people dey delete

I just wan stay fresh like brand new shimmy
Play with my money, burst your head with full remy
Nothing you wan tell me
About this street my guy
Once you broke men men dey dismiss my guy
Before my coffin drop, order one casket come
Don P If benson dey bring like two packets come
Stand untop of the clubhouse, girls dey go insane
We dey come this life finish, na to go remain
Three girls for my bed, two dey crush my rod
Half bottle of hennesy follow my come from club
One boyfriend dey call she save he name with love
But she prefer to dey with me cos money dey involve
Na mula dey rule the world, oko leave mathset

My brother say na love, tha one na e mindset
He bae dey cheat anyhow like baby wey dey purge
He name nor be finidi so leave am make e deu judge/George

Gen still dey on, AC still dey blow
NEPA still dey knock, be like say men dey owe
By pass the meter, Segun from ejeba hood
Forget this Lekki life, this Erigga you self you nor good

bottles up! put dem in the air
men dey talk, i know wetin i hear
live my life, like ion really care
cos when e bust
people dey delete
when he bust
people dey delete
when e bust
people dey delete
when e bust
people dey delete

Please Kindly drop a comment, Corrections and suggestions. Your Comment is a motivating factor for wikilyrics to perform greatly.

Tags

Post a Comment

0 Comments
* Please Don't Spam Here. All the Comments are Reviewed by Admin.

Ads Area

Disclaimer: All The Lyrics, Stories, Hymn, Poem & Anthem on Wikilyrics are submitted by various people and they have right on the contents they submitted, all the Contents on our database is for educational purposes only and are made available for free download. If you feel one of your asset should not be here please request take down.