Erigga - The Way Your Matter Be Lyrics

 Erigga - The Way Your Matter Be Lyrics

(clears throat) that alright there!


Normally I dey gbadun everything you get, everything you get

see how you straight like pencil wey dey math set

Too attractive, wetin your body Na Macbeth?

I dey always make her laugh when I dey Face one

she say music or comedy, Erriga face one

I too get sweet mouth, if Na lie kiss me

diabetes go hold you, officer Kingston

no just wan dag her, break your heart fly

we fit enter malaga go relax with sly

money big, e no tinny like who sign Ycee

that punch line make her laugh

stain my BYC


(Erigga)

swear down

E get the way your matter be

I swear down

E get the way your matter be

swear down

E get the way your matter be

Anytime you dey around body dey kpakpa me

swear down

E get the way your matter be

swear down

E get the way your matter be

swear down

E get the way your matter be

Anytime you dey around body dey kpakpa me


two (Erigga)


you no get second like clock wey the long hand break

or any song I make

your ikebe dey make men hala weke

even jazzman dey hala ewo!! chineke!!

Ask yourself chicken republic Na country?

No Na!!

Na where people take dey eat

No blame me joor I don jonze one kind

but babe how you see am, my pick up line no fine??

if I stretch you like money wey squeeze

you know say you light like breeze

the love go increase

your friends go decrease

Abi you want make dem snatch me??

Answer with kiss


(Erigga)

swear down

E get the way your matter be

I swear down

E get the way your matter be

swear down

E get the way your matter be

Anytime you dey around body dey kpakpa me

swear down

E get the way your matter be

swear down

E get the way your matter be

swear down

E get the way your matter be

Anytime you dey around body dey kpakpa me


three(Erigga)


Everything about you dey burst my sclero

scatter my kumuji, tell me your skedo

I like make we de charge, go cover one side

like congo defender, I no go play offside

I fit give you the world but Na God get am

where other people go stay abi you wan rent am??

Na joke I dey so babe no get am twisted

like Ehiz dada, enemies father

how people go hide your sugar give you salt

even good morning fit bring how are you insult

once again she say Erigga do comedy

see your face, you even resemble bovi

I tell am say I love you baby do your worst

you no dey see look around me, it's two of us

Money dey allow me let me be your purse

she say u just want dey play oya true or false?


(Erigga)

swear down

E get the way your matter be

I twerk down

E get the way your matter be

swear down

E get the way your matter be

Anytime you dey around body dey kpakpa me

swear down

E get the way your matter be

swear down

E get the way your matter be

swear down

E get the way your matter be

Anytime you dey around body dey kpakpa me


Outtro


waff town stand up



Please Kindly drop a comment, Corrections and suggestions. Your Comment is a motivating factor for wikilyrics to perform greatly.

Tags

Post a Comment

0 Comments
* Please Don't Spam Here. All the Comments are Reviewed by Admin.

Ads Area

Disclaimer: All The Lyrics, Stories, Hymn, Poem & Anthem on Wikilyrics are submitted by various people and they have right on the contents they submitted, all the Contents on our database is for educational purposes only and are made available for free download. If you feel one of your asset should not be here please request take down.