Everything Amen Timi Dakolo

 

Everything Amen Timi Dakolo Lyrics

Everything Amen Timi Dakolo Lyrics


Chorus
Everything you put your hand
(Go work)
Your name go open doors
(Amen)
You sef go be a boss
(Amen, amen, amen)

Repeat Chorus

Every hustler get hin day
(day, day)
Wey the hustle go come
Dey pay (pay, pay)
Your own e no go tey
(Amen, amen, amen)
If you dey find work
Do your own (oh, oh)
God sef go do hin own
(oh, oh)
And flesh go cover bone
(Amen, amen, amen)
If you believe it say amen
(Amen)
If you believe it say amen
(Amen)
If you believe it say amen
(Amen)

Chorus (2x)

Sister wey wan marry since
(since, since)
Aunty wey dey find pikin
(kin, kin)
One day you go born twins
(Amen, amen, amen)
Tenant wey don lose hin job
(job, job)
Landlord come dey do like god
(god, god)
One day you go be landlord
(Amen, amen, amen)
Good news go locate you
(Amen)
Watch and see e no go tey
(Amen)
If you believe it say amen
(Amen, amen, amen)

Chorus (2x)

Long-life go follow you
(Amen)
Starngers go favor you
(Amen)
Great men go honour you
(Amen, amen, amen)
One day you go sign the cheque
(Amen)
You sef go drive that Benz oh
(Amen)
This life go still make sense oh
(Amen, amen, amen)
Your children go make you proud
(Amen)
Bad people no go pull you down
(Amen)
One day you go run this town oh
(Amen, amen, amen)
You sef go spray me money
(Amen)
Baby go call you honey
(Amen)
You sef go host the party
(Amen, amen, amen)
Dangote go be your friend
(Amen)
Otedola go be your friend
(Amen)
Adenuga go be your friend
(Amen, amen, amen )
Elumelu go be your guy
(Amen)
Abdulsamad go be my guy
(Amen)
Rabiu go be my guy
(Amen, amen, amen )
Your life no go end in shame
(Amen)
Your business go bring you gain
(Amen)
If you believe it say amen
(Amen, amen, amen )


Please Kindly drop a comment, Corrections and suggestions. Your Comment is a motivating factor for wikilyrics to perform greatly.

Post a Comment

0 Comments
* Please Don't Spam Here. All the Comments are Reviewed by Admin.

Ads Area

Disclaimer: All The Lyrics, Stories, Hymn, Poem & Anthem on Wikilyrics are submitted by various people and they have right on the contents they submitted, all the Contents on our database is for educational purposes only and are made available for free download. If you feel one of your asset should not be here please request take down.