Erigga – The End Lyrics

Erigga – The End Lyrics

Erigga – The End Lyrics

 Ajuwe wan talk Now industry shut up

The line when I draw nobody fit clean am lock up

Waytin dey sup Na too much cocaina

We no be blood naw this guy Na riabina


The loyal tea of a broke man fit full four cup

Keep them garri keep watch dem no steal four cup

Small cogal money enter you benson switch

Dey chichi people help you when you no get shit


Wizzy really talk am no dey give man pass

Wayrin e deserved Ungratful Na fool here pass

No need to hug me Oko shake hand make you go

We no dey Quarrel the prayer Na make we blow


Some time e no bad if you remind your self

Say you be king no be only you crown your self

Nobody know them before Na you put dem on

Me taroh shue oyote the game still On. I n


Final Wiesel never blow the game still on

Na you go loose gad drop pad your game still on

Young kings secure bag the game still On

Who no loyal go riaja Ekume me ta Ro shew


(Rap)

Verse 2 suppose be about Ikebe

Or girl when dey give me big head Oziegbe

But no I like give una gbe Gbe gbe

Make una know this industry don buy gbege


Walls no be human being but them get ear

Before you spoil me give person observe am

Well

E fit go be my OG you know say lekki small

Waytin them talk for chevron we hear am for

phase 1


Can you imagine okro wan pass grow owner

No need for cutlass Na hand take dey cut una

Life Na Bitch see the way dem dey fuck una

Money don finish see the way dem luck up una


Block una we dey hear how much them chop una

Una hand dey hot why media no go rush una

The biggest scam Na top ten street dey watch una

We know who suppose dey there make dem knock una


All this things them dey do dem me too

But I blow different between me and you

We no be mate like past tense of old you new

Na soap them give you take baff you know waytin we chew


Career when die God raise like Lazarus

If no be social media dem for don cancel us

I dey my backyard spot dey smoke my long Kleff

I busy pass Ashawo curtain talk to don Kess


Nolimit quech the beat I wan make dem hear me well

Wear your face mask nowadays yeye dey smell

To all my real gs when be say see money

Put your hands for your chest repeat after me


Who get pass me that one no be business

I no wish you bad Jehovah Na my witness

I Dey awake Na God dey watch my tower

Fuck with my bag Na open magazine towa


If media tell you say bad Na lie I wicked

Dem say na small Crase Na lie Oh I naked

For this industry we know who don touch money

Within ourselves so Aunty no form for me


We dey see everything una dey post for gram

I take God beg no change when we meet for gorund


If dem dey tell you say bad Na lie I wicked

If dem say na small Crase Na lie I naked

For this industry we know who don touch money

Within our selves so Aunty no dey form for me

Please Kindly drop a comment, Corrections and suggestions. Your Comment is a motivating factor for wikilyrics to perform greatly.

Tags

Post a Comment

0 Comments
* Please Don't Spam Here. All the Comments are Reviewed by Admin.

Ads Area

Disclaimer: All The Lyrics, Stories, Hymn, Poem & Anthem on Wikilyrics are submitted by various people and they have right on the contents they submitted, all the Contents on our database is for educational purposes only and are made available for free download. If you feel one of your asset should not be here please request take down.