Lyrics of Sapa.com By Prinx Emmanuel
My mama tell me say anything wey be competition make I wash hand
Make I no put my eye where my hand no reach make I calm down oh ah
Make I no dey do do do when I no get compass
Make I no go owe because I want to show say I be the top class
Bridge
No use your last card dey Dorime (Dorime)
This update wey I dey give you no be play
Before you go realize wetin dey sup you don log in
Chorus
Sapa.com
E no go good if you log in to sapadotcom
Sap.com
You no go know when you login to sapadotcom
Verse 2
So man I use my head and I off my data
Make I no wear swimming trunk I dive into sapa
Make I no compete with ritualist the least wey dey my hand I blow am like catarrh
So cut your coat according to your size
Come make I show my bata hand
If I no get am I go Japa
If I no fit buy champagne I go 5 alive oh no
Every other day na for billing
As you commot for house the only thing wey you dey hear ( Hello sir Current or savings )
Chorus Sapa.com
E no go good if you log in to sapa dot com
Sapa.com
You no go know when you login to sapa dot com
Disclaimer: All The Lyrics, Stories, Hymn, Poem & Anthem on Wikilyrics are submitted by various people and they have right on the contents they submitted, all the Contents on our database is for educational purposes only and are made available for free download. If you feel one of your asset should not be here please request take down. (alert-warning)